Meet Françoise Bettencourt Meyers, di first woman to gada $100bn fortune
Oréal heiress Françoise Bettencourt Meyers don become di first woman to gada $100bn (£78.5bn; €90.1bn) fortune, according to one ranking of di richest pipo for di world.
Di French beauty empire wey her grandfather start dey on record for dia best stock market performance in decades.
L'Oréal shares bin rise to a record high for Paris on Thursday.
Di firm don see dia sales bounce back afta di pandemic, wen pipo under lockdown bin dey use less makeup.
Di net worth of Ms Bettencourt Meyers, wey be 70-year-old, cross $100bn on di Bloomberg Billionaires Index, wey make her di 12th richest pesin for di world.
#francoise #bettencourt #meyers #francoisebettencourt #meyers #francoisebettencourtmeyers #francoisebettencourtmeyersfamily #viral #foundation #donation #donate #france #brazil #spain #usa #america #india #support #help #newzealand #retire